Joke: Chicken & Red Wine

E get dis particular restaurant wey i dey chop for wuse. E get one oyibo wey dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish, him go shout “heey!”, so i wonder wetin dey make am shout. I decide to chop wetin di oyibo dey always chop so maybe me self go shout too. When i reach d restaurant last week friday, I order wetin di man dey chop, dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout, i even collect xtra plate, but i still no shout. Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na N45,000, then d xtra plate na another 45,000 na then i come shout heyyyyyyyyy! heyyyyyyyyy!! heyyyyyyyy!!! heiiiiiiiiiii!!!!… till i reach house i still dey shout.. HAHA!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Read previous post:
Joke: Beans Story

Close